E don tey wen yansh dey back o, and e don tey wey Demi reash this yonda.
I know na, make una no vex. Na chop carry me wakea comot because as you peepo no gree follow me tok, the tin tire me small. And as e be say person no dey make bread and butter for this yonda na, I suppose borrow myself brain make I go find chop money and rent money before my baba Landlord throw my clothes comot for my small flat na.
Anyway Yoruba peepo tok say if something no get yansh, woman no dey answer 'ikumolu', so e get reason when I say make come quick come shek dis side.
Na this piksho of Dakore Egbuson wen I see on top Facebook make me vex to tok!
Abeg see babe!
Check out that figure in that gorgeous blue dress! I bin dey tok am say blue and purple always dey fit us black girls. Come look the hair and the jweries again!! Everything on FLEEK!!
Anyway me sef don dey exercise. Na insai the same trouser we go put leg because me sef must be a bisg ghel!
Yes os cof!!
Anyway how your Sunday dey go now? I dey open for invitation to chop tins o. Fried rice, jollof even if na small pounded yam with egusi soup sef dat one too I go manage. Remember say shearing is kiareen o.
Anyway, if you refuse to invite me, I pray say make your alarm no work tomorrow moreen.
Happy Sonday!